Ah but what dey wrong Wendy Shay sef?
The boy already dey park him hands like church usher wey fear fornication. You see how Lasmid no even allow the palm rest full on her? He dey hold himself like “this one na video o, no be bedroom”.
She still force the energy, pull the hand, wind the waist, act like the camera no dey. Lasmid sit there like man wey them tell am “just smile, no touch”.
So now people dey shout she do am dirty, meanwhile the guy already dey restrict himself from the jump. The disrespect no start from her pulling the hand… e start from she no read the body language wey already dey say “I no come play that one today”.