“Exposure”
Una dey sabi whine pesin sha.
lol I remember one backup singer wey I wan give % of my royalties based on say I wan turn am to my official backup singer. Mind you this na when I don dey on serious motion o. She say she no want my exposure say na her $100 she wan dey collect. Now the person wey dey give am mouth don drop am dey use another person. Exposure can never be enough. If you like make e be Drake you dey do for so if lil baby call you, you go tell am say na only $ you want because you dey with Drake? Her cs dey gas am e dey sweet am. Na why many of una no fit make am. No wisdom! And I sure die say she no dey see any % for that side. She make me kon even realize say my manager wife sef be like Adele.